30/11/2025
2027 BSHOA ELECTION: HONOURABLE IKWULONO NA THE MAN WEY SABI TO REPRESENT WELLA
No be lie say as the 2027 Benue State House of Assembly election dey near so, the Agatu State Constituency go need pesin wey sabi represent wella. Pesin wey don serve before na him fit know the style to serve well again.
Dat pesin na Honourable John Anthony Ikwulono (JAI), wey many people dey call Mr. Simple Solution. The man na pesin wey sabi how to talk for him people. E sabi book well well, and him experience for communication tanda gidigba. When all of us support am and make am the next Benue Assembly member wey go represent us for Agatu, e clear say Honourable Ikwulono go do well.
Him don promise we people say after dem swear am in as member of Benue Assembly, e go work well well to bring plenty jollification; business and job opportunities for we youths, empowerments for we farmers, market women plus better life for we papa and mama dem. Therefore, make we no make mistake for 2027 o. Make we no look for any other choice but vote for our man, Mr. Simple Solution, Honourable Ikwulono, because him na de man wey sabi.
Oya, come make we all join the JAI Movement for the Agatu wey all of us go dey jolly dey go.
JAI BSHOA 2027 Media/EXCO Team & Support Group
November 29, 2025